Skip to main content

Posts

Showing posts from March, 2014

Better go show

Brother e don tey wey you dey find admission You don discourage and you dey give worry permission Get ready you go resume this november Bros cheer up and mark am for calendar you dey here dey worry admission Start enjoyment God been dey fix your employment Aunty you go carry your pikin no worry You go come share your testimony Oya begin dey practice your Thanksgiving dance start to dey ask mama for agbo, no give sadness chance Your time has come to bragadaba Now is your time to taka rawa Oboy the hustle is very real Time dey come when we go just dey chill Work hard and leave am for God Arrange yourself better dey come maintain your position better go show Jesus will make all of us glow Hey guys am back for good. Watch this for more of the poetic me.