Skip to main content

Better go show

Brother e don tey wey you dey find admission
You don discourage and you dey give worry permission
Get ready you go resume this november
Bros cheer up and mark am for calendar
you dey here dey worry admission
Start enjoyment God been dey fix your employment

Aunty you go carry your pikin no worry
You go come share your testimony
Oya begin dey practice your Thanksgiving dance
start to dey ask mama for agbo, no give sadness chance
Your time has come to bragadaba
Now is your time to taka rawa

Oboy the hustle is very real
Time dey come when we go just dey chill
Work hard and leave am for God
Arrange yourself better dey come
maintain your position better go show
Jesus will make all of us glow

Hey guys am back for good. Watch this for more of the poetic me.

Comments